Storing perfume in fridge - na good or bad idea? - BBC News Pidgin (2024)

Storing perfume in fridge - na good or bad idea? - BBC News Pidgin (1)

Article information
  • Author, Komla Adom
  • Role, Senior Journalist, BBC News Pidgin
  • Reporting from Accra

One of di most important tins wey pipo dey use for dia everyday life na perfume.

For many pipo, e dey very essential bifor dem go step out.

In fact, without perfume, some pipo say dem dey feel incomplete.

Like Malise Omoloye wey be social media marketing consultant.

Im tok say im no dey step out without perfume.

“Na compulsory for me say I go step out wit perfume, e dey give me ogbonge confidence and ego,” Malise tell BBC News pidgin.

Many pipo dey like Malise, but odas too neva dey care much.

Some pipo too dey forget to use am if dem dey hurry, like Beryl Richter.

“I bin dey use perfume, but sometimes I fit dey forget to use am wen I go rush go town.”

Sabi pipo for di fashion and lifestyle industry tok say good fragrance na accessory for body.

Ogbonge American actress and musician Jennifer Lopez for previous interview say she dey love to wear fragrance sake of “e dey boost my energy for di day, wey I get different perfumes for different moods.”

Pipo like to invest for perfumes and fragrances, dem fit buy plenty for dia wardrobe.

Some dey inspired by di one dia favourite celebrity dey use, wey go make dem wan also wear di same perfume.

From ogbonge designer brands to di odas wey everyday pipo fit afford, di fact be say dis perfumes dey important. But e dey good to store dem inside fridge?

Storing perfume in fridge - na good or bad idea? - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, MAISON YUSIF/INSTAGRAM

Yusif Meizongo Junior of ‘Maison Yusif’ manufacturers don create ova 20 custom fragrances wey dey inspired by Ghana rich heritage; wey dey travel beyond di kontri.

Im gat clients wey bin dey store dia perfumes and fragrances inside refrigerator.

Sabi pipo like 'Maison Yusuf' tok say alcohol wey dey inside perfumes (ethanol) get very low freezing point, so e no go freeze inside standard refrigerator if pesin put am inside.

For pesin wey gat experience for creating dis fragrances and perfumes - Yusif Meizongo tell BBC News pidgin say, to store dis perfume inside refrigerator gat im own benefits and bad sides.

Storing perfume in fridge - na good or bad idea? - BBC News Pidgin (3)

Why storing perfume inside fridge na good idea

Recently, pipo on top social media bin dey tok about how dey keep dia perfume inside fridge.

James Ansong begin to dey store im perfume inside im family fridge months ago afta im see one perfumer dey tok about am for instagram.

“Since I start to put my perfume inside fridge, e don dey feel fresh always.”

“I also sabi say di perfume no dey finish fast fast like di time I bin dey put on top drawer for bedroom,” oga James tell BBC News pidgin.

Odas begin dey wonder if di scent from food and oda tins inside di fridge no go enta di perfume.

Storing perfume in fridge - na good or bad idea? - BBC News Pidgin (4)

Wia dis foto come from, MAISON YUSIF/INSTAGRAM

Oga Yusif Meizongo Junior tok say to dey keep dis perfumes inside fridge get impact on top di molecular structure, chemistry and overall scent of di fragrance.

Some of di benefits if pesin store dia fragrance inside fridge according to Yusif include:

1. E dey preserve volatile components

Perfumes gat some chemical compounds wey dey fit evaporate or break down ova time.

To keep dem inside di fridge go slow down di process of evaporation wey im go maintain di fragrance.

2. E dey give protection from heat and light

Heat and light fit break down di chemical bonds inside di molecules of di fragrance - wey im go change di scent of di perfume.

Di fridge dey offer dark, cool environment wey dey protect/shield di perfume.

3. E dey extend shelf life of di perfume

OgaYusif say to dey keep perfume inside fridge dey make am dey last longer.

Dis na becos di temperature inside di fridge go slow down di chemical reactions wey dey cause di perfume to become weaker.

Refrigeration fit make di perfume last longer; for many pipo, na so dey want am, say make e last long.

4. E dey maintain di integrity of di perfume

Environment wey dey cool dey help to keep di original composition of di perfume, by reducing di chance of molecular breakdown.

Dis also fit to cause disadvantage sake of every fragrance gatz to mature - so all di ingredients go come togeda and work wit one anoda well well.

“From experience, we know say di older di fragrance, di better di scent, just like red wine,” oga Yusif tell BBC News pidgin.

Cold temperatures fit to stop di fragrance from maturing.

So you gat to ensure say di temperature inside di fridge wia pesin go dey store di perfume, neva dey too cold.

5. Reduced exposure to air

To store perfumes inside fridge dey prevent dia exposure to air.

Dis dey slow down wetin sabi pipo dey call oxidation - wey be one of di main causes for fragrance to destroy (degradation).

Storing perfume in fridge - na good or bad idea? - BBC News Pidgin (5)

Wia dis foto come from, Getty Images

Side effects of storing perfumes inside fridge

Despite di fact say storing di perfume inside fridge gat many advantages, e also gat some disadvantages.

1. Condensation

If you don dey take di perfume bottle in and out of di fridge, e fit to cause wetin dem dey call condensation.

Di constant temperature fluctuations (small time e dey cool inside fridge, small time you carry comot for heat) go spoil your perfume.

If di fragrance dey hot and dey cold a lot, im dey make di perfume to dey sweat and condensation fit enta inside di fragrance and cause unwanted chemical reactions.

Dis go affect di fragrance ova time and e fit make di perfume lose im actual scent.

2. E dey affect di thickness of di perfume

Colder temperatures dey make liquid don dey become thick; dis fit affect di process of spraying and how di perfume don dey feel for di skin.

3. E fit absorb odour

If you no seal di perfume bottles well well, di perfumes fit to absorb odours from oda items wey dey inside di fridge.

You no want make odour from meat, fish and vegetables to enta your perfume.

If dis happun, e go change di original scent of di perfume.

In summary, di constant cool temperature inside di fridge dey ensure say di perfume bin dey stored for “optimal environment, wia dey free from fluctuations wey don dey happun at room temperature.”

Yusif Meizongo Junior, di perfume expert, say you gat to leave your perfume inside fridge (if dat be how you wan do am) until im go finish. If you interchange di temperature, den condensation go happun.”

Im tok say “make sure di bottles dey tightly sealed so dat e go prevent condensation and odour absorption.”

As tins don dey clear now, you fit to decide wetin you go do and how you go store dat perfume wey you carry moni take buy.

Na your choice!

Storing perfume in fridge - na good or bad idea? - BBC News Pidgin (2024)

FAQs

Should you store your perfume in the fridge? ›

2 - Keep your fragrance out of the cold

Despite what some may claim, storing perfume in the fridge won't help preserve it for longer. In fact, chilling your fragrances may have the opposite effect, breaking down scent molecules and causing your perfume to lose its overall depth.

Where is the best place to store fragrances? ›

“Store your fragrance in a cool, dry, dark place. I always recommend your closet or a dresser drawer. Some people keep them in the fridge. You don't have to go that far, but when you store them correctly they will last you for years and years,” she continued.

What is the best temperature to store perfume? ›

Keep your perfume in someplace cool and constant. Make sure your bottle is in a spot free of polar temperatures — whether hot or cold. 60 degrees is the sweet spot you should aim for.

Does perfume go bad in storage? ›

Some will begin to expire in less than a year and others will last upwards of 10 years. However, three to five years is the average shelf life of a fragrance. According to experts, perfumes with heavier base notes will last the longest. Some people compare these perfumes to a fine wine—they get better with age.

Does perfume last longer in the cold? ›

People tend to wonder whether perfumes last longer in cold weather. The answer is that cold weather can actually help prolong the lifespan of your wardrobe scent due to the aroma evaporating more slowly, which means the scent will linger on your skin for longer periods of time when it is cold.

How to make old perfume smell good again? ›

But, if you've got a leftover scent that's past its best, you may be able to bring back some of its former glory by utilizing heat. The heat from the lamps or bulbs can help to disperse the scent throughout the room, while the air from the fans will circulate it around.

Where is the best place to put perfume? ›

Spray it onto your pulse points.

It's places like the inside of your wrists, inner elbows, below your belly button, behind your ear lobes, and the back of your knees. These warm spots on your body emit extra body heat, which helps to naturally diffuse a scent.

What is the best material to store perfume in? ›

This is why plastic containers may retain the scent or texture of stuff you placed in them even after you have washed them several times. Only use glass containers that can be easily cleaned and reused for your perfumes. This is a very simple and practical way to help the environment.

What product makes perfume last longer? ›

As fragrances cling to emollients keeping your skin well-moisturized can help perfume last longer. Whilst any lotion can provide hydration to your skin prepping skin with a scented body wash and scented body lotion which match your signature scent can create a fully immersive fragrance experience.

What makes a perfume last the longest? ›

Moisturise Your Skin Before Application

If you are wondering how to make perfume long-lasting, then hydration is the key. Perfumes have the power to cling to emollients which increases the longevity of your perfume. So, make sure to moisturise your skin before applying your most-loved scent.

How can you increase the shelf life of perfume? ›

Prolonging Your Perfume's Lifespan

Direct sunlight, fluctuating temperatures, and exposure to air can break down the fragrance compounds, leading to a loss of scent quality. To preserve the essence of your beloved Cherry Wonderland or Grunge Rock Tuberose, it is advisable to store them in cool, dark places.

Is refrigerating perfume good? ›

Maintains freshness: Perfumes are made up of volatile compounds that can evaporate over time, especially when exposed to heat and light. By storing your fragrance in the fridge, you can help to slow down this oxidation process and keep your perfume smelling fresh and vibrant for longer.

Where is the best place to store perfume? ›

“The ideal place for perfume is a dry, dark area,” says Serrano-McClain. “Some people go so far as to store their perfume in the fridge for longevity, but that's not realistic for everyone. A closet or cabinet works just fine.”

What temperature ruins perfume? ›

The best storage environment for perfume is one that maintains a consistent temperature, ideally between 15°C and 25°C (59°F and 77°F). Avoid places where temperature fluctuations are common, like bathrooms or near windows.

How do you store perfume so it doesn't evaporate? ›

“The ideal place for perfume is a dry, dark area,” says Serrano-McClain. “Some people go so far as to store their perfume in the fridge for longevity, but that's not realistic for everyone. A closet or cabinet works just fine.”

How long does perfume last after opened? ›

Once opened, perfumes can last between three-to-five-years on average – though it is advised that a fragrance should ideally be used within two to three years. This is, however, dependent on a few different factors, such as the perfume's storage conditions as well as its ingredient formulation.

Does perfume stay fresh if unopened? ›

However, generally speaking, a perfume can last for years (even decades) if it is unopened. Once a perfume has been opened, the fragrance begins to oxidise, which eventually causes the smell to fade over time. A good tip is to only open a new perfume when you have used up another.

References

Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Rueben Jacobs

Last Updated:

Views: 6256

Rating: 4.7 / 5 (57 voted)

Reviews: 88% of readers found this page helpful

Author information

Name: Rueben Jacobs

Birthday: 1999-03-14

Address: 951 Caterina Walk, Schambergerside, CA 67667-0896

Phone: +6881806848632

Job: Internal Education Planner

Hobby: Candle making, Cabaret, Poi, Gambling, Rock climbing, Wood carving, Computer programming

Introduction: My name is Rueben Jacobs, I am a cooperative, beautiful, kind, comfortable, glamorous, open, magnificent person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.